Wednesday 30 July 2014

Side Effects: Reasons why some girls will never get married! - Anna Amorighoye


You don ever take time check your area well well, if you never do am before, try am first thing tomorrow you go observe say plenty of your area girls don Port go another location….yes o even girls don de port now ooo…wetin dem de do na be say, dem go arrange demself reach like four or five go rent one apartment for one kind remote area where anybody nor know dem, den dere don turn automatic sisters.

I know say you go de ask yourself why dem de behave like dat abi? Okay ask yourself why you go port go another network, Yes na because of service abi? These girls de find husband and the search norbi easy one o and for their area dem know the size of every guys d*ck. Tell me as a young man like yourself you go gree marry one girl wen don blow all your guys? And as a girl also you go let your brother marry any girl wey you know very well say she don cast? The answer is capital NO.


Wait before you start to judge me say I too de blunt, I won remind you say to some of all these girls wey never marry 100% of the problem na their fault!…wait make I land…almost all the girls for this town no ready to build a life with a guy, all wetin dem dey after na material things, now I nor say na bad thing if as a girl you want all those fancy things oo, na de way God take create woman be dat, but wetin de wrong be say na for you as a girl to engage yourself in some unholy activities with different people just to get one thing or the other…I nor need remind una wetin girls do just to get blackberry phones na.

Okay think am na, a girl wen nor de work how you expect her to take de keep up with all those latest models and different brands of phones and tabs. If their boyfriend nor fit buy am for them dey go get am from someone else like their “UNCLES” (Uncle- the name a girl can use to confidently call her other boyfriends). What dey fail to understand dat everything gets old and outdated over time just as dem too dey get old and outdated over time, giving room for younger girls to get married na the shame and urgency de make the Port go a different location…….if you are faithful to one guy right now, my advice is for you to remain faithful because people de watch you and even if the guy disappoints you later, let him, don’t try to get back at am by being promiscuous because it will only ruin you.
Keep yourself and sooner than you think a very responsible and standup guy will come knocking.

Written by Anna Amorighoye for PapaWarri© the Warri Official Blog™,  inspired by Life.

No comments:

Warri Official Blog™ © 2014. All Rights Reserved. Powered by PapaWarri